Jump to content

Perpetua and Felicity

From Wikipedia


Perpetua an Felicity (for Latin langwej: Perpetua et Felicitas) dem bi two Kristen wey kpai bikos of dia faith for 3rd Senturi. Vibia Perpetua dat time jos mari an e na wuman wey go skul wel wel. By di time wey pipo kil am, Vibia Perpetua na 22 year old an e boi pikin de im hand wey e dey tekia of. Felicity, wey bi di sekod wuman wey kpai bikos sey e na Kristen na slave wey dem put for inside prison wit Perpetua. Dat time, wen don wan kil Felicity, e get belle. Dey kil dis two wuman join di plenti pipo wey kpai for Carthage wey de ples wey Roman Govamet dey kontro for Afrika.

One buk wey di nem na The Passion of Perpetua and Felicity tok dia Tori. For wetin di buk tok, e sey nafive pipo dey kil dat time bikos dem Emperor Septimius Severus dey do bi-day dat day. For di bi-day parti, dey yuz dos five pipo as game.Di nem of di five pipo wey dem kil dat day na: Perpetua, Felicity, Saturninus, Secundulus,an Revocatus. Saturninus an Secundulus bi free-man but Revocatus na slave. All of dem bi Kristen wey neva baptais. One pesin kom leta join dem to mek pipo wey kpai dat day bi six pesin. E nem na Saturus. Na Saturus imsef go yuz im mouth tok sey e na kristen for front of majistrate. Na afta Perpetua don kpai pipo kom rait wetin e tok for di buk.

Di Tori if Perpetua start for di buk wen im an e papa dey kwurel. Wetin kos di kwurel bi sey; e papa wan mek Perpetua no do Kristen again. Perpetua no gri an e do wota batisim bifor dey kari am go prisim wey de Carthage. E rait wetin e sofa for one buk wen e dey kari about wey oyinbo pipo dey kil Diary.

Perpetua tok about di kind bitin wey e risiv bifor dem leta kil am. E still tok sey for di prisin, evri wey hot no bi smol, di prisin polis bad karata, an how dem no gri mek e no give e smol pikin breast. Perpetua also described how the prison conditions improved after she was able to bribe the guards so that she and the other martyrs were moved to another part of the prison, with her infant. Her physical torment was also eased after she was able to breastfeed her child. Perpetua described bodily ailments in detail and the most common in her narrative was the cycle of pain and relief she would feel in her breasts.

The day before her martyrdom, Perpetua don get vision for were she being see herself dey defeat a savage Egyptian and kon mean say she go gats to do fight no be bush animal, but with the Devil himself.